For the streets oh!
Orlando no time wasted
No time to waste, no time to dey whine
From dawn till dusk broda man dey find
Better tomorrow dey for my mind
Wetin concern me with giving up?
My hustle go pay, I go fill my cup
Naija no go kill us, we no go stop
Till we reach di top, we go rise up
Hustle till kingdom come oh!
Better days go surely come oh!
We no dey tire, we dey run oh!
Our time go reach, we go don blow!
Hustle till kingdom come oh!
Hope dey for tomorrow sun oh!
Street boys we dey hold am strong oh!
We go chop life till we don! because we came from street we must shine for street
See dis street life e no easy at all
But man must stand, man no fit fall
Everybody dey hustle, big and small
One day our glory go cover us all
From Mushin to Oshodi to Yaba
Every corner, every area
We dey grind, we go see better tomorrow sha
Hustle till kingdom come oh!
Hope dey for tomorrow sun oh!
Street boys we dey hold am strong oh!
We go chop life till we don!
E go better!
We go hammer!
No shaking!
Ceo lucky I see you