Frobits
🎵 A song made on Frobits

Obidient We Stand (Remix)

0:000:00
Download
Reply with a song
Lyrics

Omo! Make we gather for N.D.C!

The Big Shark don form am!

Peter Obi and Kwankwaso, we go dey OK!

New Nigeria dey here oh!

Every four years same wahala dey repeat

Politicians dey promise but we never see am complete

Youth dey hungry, light no dey, fuel cost scatter

But this time around, we no go free for butter

Peter Obi and Kwankwaso, na the men wet sabi structure

No be talk talk , dem get track records proper

Anambra and Kano boys wet turn state to better

Now dey wan do same for the motherland, e choke!

New Nigeria is possible oh!

Make we get am right this time, no be joke!

Peter Obi and Kwankwaso, çarry we go there! We go dey OK!

No more suffering, no more wahala everywhere

New Nigeria is possible oh!

Youth dem ready we go vote, we no ho fall our hand

Peter Obi and Kwankwaso, na the man for the plan!

Let's go there! We go dey OK!

From Lagos to Abuja, from kano to PH

Everybody don tire for the same old play

We wan see school wet work, hospitals wet dey save

Road without potholes, NEPA wet no misbehave

E no dey do eye service, e no dey spray money

E wan build system, make Nigeria turn honey, Job go dey for Naija youth

Obidient movement, we stand for wetin dey right

This election, we go shine our light!

New Nigeria is possible oh!

Make we get am right this time, no be joke!

Peter Obi and Kwankwaso, carry we go there! We go dey OK!

No suffering, no more wahala everywhere

New Nigeria is possible oh!

Let's go there! Our mumu don do!

Vote for N.D.C, is the party!

The Big Shark, I hail!

More songs by Pdorwalter Listen to songs created by others
FROBITS