Ehen... oya now
Make I yarn you something
Orlando no time wasted
I don climb mountain, reach the peak oh
E be like say na me and God dey speak
People dey hail me for street, chai
But inside my heart, e dey cold like ice nobody knows what man is going through nobody knows
Success don come with heavy price
Everybody wan collect, nobody wan sacrifice but sacrifice is a must
I get money for pocket, awards for shelf
But when night come, I dey talk to myself
Lonely at the top, lonely at the top oh
Nobody fit reach where I dey
Lonely at the top, lonely at the top
Chukwu, abeg make person stay
I don win everything but e get wetin I lose
Success sweet but the silence dey confuse
Lonely at the top, lonely at the top
God, make somebody understand my pain
They say "omo, you don hammer"
I just dey smile, I no fit tell them wahala
The higher you go, the colder e dey be
Friends wan disappear like NEPA light, you see?
Family dey call only when them need
Nobody wan know how I dey bleed
I dey pray say make God send me companion
Somebody wey go stay, no be champion
Lonely at the top, lonely at the top oh
Nobody fit reach where I dey
Lonely at the top, lonely at the top
Chukwu, abeg make person stay
I don win everything but e get wetin I lose
Success sweet but the silence dey confuse
Lonely at the top, lonely at the top
God, make somebody understand my pain
Ah-ah, see gobe
Success na beautiful burden
God abeg oh... No time wasted abeg