Ayy, listen oh
My name is fortune,am Sam fortune
For all my queens out there
This one na for una
See the way dem dey call you "babe" for weekend
But Monday come, e no fit text back
You deserve better thing, no be small thing
Your body na temple, no be playground for play
Some boy go promise you heaven and earth
But when morning reach, e don disappear
Na why you go wise up, shine your eye well well
Your future too bright make you follow wayward
Know your worth, know your worth oh
You too precious, you no be everybody
Know your worth, know your worth oh
Choose yourself first, no dey sorry
Glory! Hallelujah!
You are royalty, no forget am
Know your worth, know your worth oh
Make better choices, no dey play!
See these girls wey dey move with sense
Dem dey focus on their hustle, dey chase their dreams
No time for one night, no time for games
Dem know say true love go find dem someday
You fit wait, you fit pray, you fit grow
Build yourself up, make your money flow
The right person go see your light and stay
No need to give your body away
Let's go!
Know your worth, know your worth oh
You too precious, you no be everybody
Know your worth, know your worth oh
Choose yourself first, no dey sorry
Thank you Jesus!
You are royalty, no forget am
Know your worth, know your worth oh
Make better choices, shine your crown!
Am fortune,Sam fortune!
We rise!
No stopping!
You are greatness, omo!
Know your worth oh
If anything do you your family go cry. Stop selling your bodies