Intro (Spoken):
Nigeria my country, How long we go dey cry? How long innocent people go dey die? Students, teachers, farmers, travelers, Everybody dey live for fear. Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Enough to enough!
Chorus:
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Blood no suppose flow for our land o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Make peace and safety come again o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Leave our children make dem learn o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Nigeria must rise again o
Verse 1:
Teacher wan teach, e dey fear kidnapping Student wan learn, e dey fear shooting Farmer wan plant, e no fit reach farm Traveler dey pray before every journey
Village dey empty, people dey run Mothers dey cry for their missing sons,
Papa no fit sleep,
pikin no fit rest Fear want turn landlord to a stranger
Yoruba Chant;
Ọlọ́run jọ̀wọ́ gbà wá o Àwọn aláìṣẹ̀ ń sunkún o Kí àlàáfíà padà bọ̀ wá Kí okàn wa lè tún balẹ̀ o
Chorus:
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Blood no suppose flow for our land o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Make peace and safety come again o
Verse 2:
Dem carry gun enter worship place Dem carry fear enter market place Dem block highway, kidnap innocent souls Many families never recover
You dey end people life, You dey shout allah's name, But wetin innocent children do you?
You dey spread terror, You dey spread sorrow, Who send you come destroy your fellow human being?
God of mercy no dey happy with killing, God of justice no dey drink innocent blood, Any person wey use religion cover evil, Na judgment e dey call for himself.
Bridge (Fuji Style Call & Response)
Call: Who go save Nigeria?
Response: God go save Nigeria!
Call: Who go protect our children?
Response: God go protect our children!
Call: Who go shame the wicked?
Response: God go shame the wicked!
Call: Who go bring peace to our land?
Response: God go bring peace to our land!
Prayer Section
Every kidnapper wey no repent, Every terrorist wey no repent, Every bandit wey no repent, Their evil plan go fail!
Aṣẹ!
Every innocent person wey dey cry today, God go wipe your tears away.
Aṣẹ!
Nigeria go see better days.
Aṣẹ!
Final Chorus:
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o!
Teachers must teach in peace o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Students must learn in peace o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Farmers must work in peace o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Travelers must move in peace o
Enough to enough! Ọ́ tó gẹ́ẹ́ o! Nigeria shall overcome!
Outro
North, South, East and West, them say We be one people.
So No to terrorism. No to kidnapping. No to banditry. Yes to peace. Yes to justice. Yes to Nigeria.
Ọ́ tó gẹ́ẹ́! Enough to enough!
----
Daixie Banks
Bankizill Om'Oba Kétu say sooo.
Adéyẹmí one..
Baba Richard
Baba Mercy
Baba Emswift Omo mi mí Europe
Baba Debbie.
The O O 1!
Ìmọ́lẹ̀ swat!