Frobits
🎵 A song made on Frobits

My Paddi, Why?

0:000:00
Download
Make your own song
Lyrics

[male vocals] My

Paddi

[male vocals] My

Paddi

I

dey

call

you

my

paddi,

i

dey

see

you

as

my

broda.

My

paddi

wetin

com

sub,

why

you

com

dey

dig

unda

my

feet,

com

dey

set

trap

for

me.

wen

i

no

be

antelop.

I

dey

hiar

your

rumour,

but

i

no

send

you,

i

dey

hiar

your

lie

lie,

i

dey

mind

my

business,

dem

dey

talk

everytin

wey

you

talk

for

my

back,

e

no

pain

sha.

I

no

see

you ,

na

God

go

judge

you.

You

dey

spread

rumour

for

my

back,

dey

smile

for

my

front,

dey

gossip

wetin

i

no

do,

dey

talk

wetin

i

no

talk.

I

no

hate

you,

i

no

dey

beef

you,

no

carry

my

mata

for

head

like

pure

wata

for

traffic.

Na

baba

God

dey

bless,

na

baba

God

dey

promote

pesin.

No

go

carry

yeye

carata

com

dey

fine

promotion,

my

broda

you

no

go

get

am.

De

pesin

wey

you

sell

your

broda

give,

no

go

eva

trust

you.

I

dey

hiar

your

rumour,

but

i

no

send

you,

i

dey

hiar

your

lie

lie,

i

dey

mind

my

business,

dem

dey

talk

everytin

wey

you

talk

for

my

back,

e

no

pain

sha.

I

no

see

you ,

na

God

go

judge

you.

Commot

monkey

hand

for

soup

before

e

becom

human

hand.

stop

hating,

i

no

hate

you,

you

be

my

broda

and

paddi.

I

no

dey

look

for

wetin

dey

inside

your

pocket,

na

my

own

i

dey

fine

for

bush.

De

more

you

dey

spoil

my

name,

de

more

baba

god

go

dey

decorate

me,

him

go

prepare

my

table

before

my

enemies

and

haters,

him

go

fill

my

cup

wit

wine

and

him

go

run

am

ova

and

ova.

I

dey

pity

my

haters,

becos

na

hypertension

go

kill

dem.

I

no

go

stop,

hundred

haters

no

fit

stop

me,

one

thousand

and

one

enemies

no

go

fit

stop

me.

Baba

God

stand

for

my

back

like

rock,

i

no

dey

shake.

I

dey

hiar

your

rumour,

but

i

no

send

you,

i

dey

hiar

your

lie

lie,

i

dey

mind

my

business,

dem

dey

talk

everytin

wey

you

talk

for

my

back,

e

no

pain

sha.

I

no

see

you ,

na

God

go

judge

you.

I

no

dey

compet

wit

enibodi,

na

my

yesterdey

i

wan

beta

pass,

no

be

you.

I

no

dey

see

you.

Wen

i

look

mirror,

i

no

dey

see

you,

na

my

self

i

dey

see.

Continue

dey

hate

who

no

send

you

and

your

future.

Enitin

wey

you

becom,

na

for

yasef,

enitin

wey

i

becom

na

for

myself.

No

dey

spread

rumour

about

wetin

no

happen,

no

dey

talk

lies

about

wetin

wey

no

dey

exist.

Sky

too

wide

for

all

de

birds

to

fly,

mosquito

no

fit

collide

wit

butterfly.

Fly

your

fly,

make

i

fly

my

fly.

Live

your

life,

make

i

live

my

life.

Life

no

hard,

na

envy

wan

make

look

like

Idanre

hill.

I

dey

hiar

your

rumour,

but

i

no

send

you,

i

dey

hiar

your

lie

lie,

i

dey

mind

my

business,

dem

dey

talk

everytin

wey

you

talk

for

my

back,

e

no

pain

sha.

I

no

see

you ,

na

God

go

judge

you.

You

dey

wish

make

i

fall,

you

dey

wish

make

your

rumour

kill

me.

you

dey

talk

lie

lie

make

odas

follow

you

pursue

me.

You

wan

block

me,

you

wan

push

me

down.

Ask

questions

bro,

becos

na

your

grave

you

dey

dig

so.

I

dey

hiar

your

rumour,

but

i

no

send

you,

i

dey

hiar

your

lie

lie,

i

dey

mind

my

business,

dem

dey

talk

everytin

wey

you

talk

for

my

back,

e

no

pain

sha.

I

no

see

you ,

na

God

go

judge

you.

Small

fever

you

don

dey

shout,

God

show

merci,

small

headache,

you

tink

sey

death

don

com.

My

paddi,

comot

hand

for

bad

tin.

Clean

hands

no

dey

beg

for

merci.

Becos

merci

sabi

who

deserve

am.

I

dey

hiar

your

rumour,

but

i

no

send

you,

i

dey

hiar

your

lie

lie,

i

dey

mind

my

business,

dem

dey

talk

everytin

wey

you

talk

for

my

back,

e

no

pain

sha.

I

no

see

you ,

na

God

go

judge

you.

I

no

be

bush

meat,

i

no

resemble

antelop,

i

no

live

for

bush.

You

be

my

childhood

friend

and

broda,

wetin

com

sub?

Why

you

com

dey

behave

like

Judas

Iscariot.

Na

god

dey

bless,

no

be

hate

and

lies.

More songs by Udehani Listen to songs created by others
FROBITS