Yo yo yo!
Orlando no time wasted don land oh!
Make I teach una the ten commandments
For this street oh!
E choke!
Number one oh, never trust person wey dey smile too much because them be dangerous snake
Number two, make sure say your money dey for different place to avoid been called oldtaker God forbid
Number three, no dey show off wetin you get for social media if you want to go far
Number four, respect your elders, e go save you wahala because them have overcome many whala wey you don't know
Number five, your word na your bond, no dey lie anyhow because word is power
Omo see this life oh!
Ten commandments for the street oh
If you wan survive, make you follow am
Ten commandments for the hustle
Na the code wey go guide you
E choke! E choke!
Ten commandments oh!
Number six, no dey beef person wey dey help you make you no go miss your help
Number seven, save your money, rainy day go come so that money go save you tomorrow
Number eight, mind your business, no be everything concern you know wen to talk because is better for you not to cap than to cap rubbish
Number nine, stay loyal to your day one people
Number ten, fear God, e go cover you
Wahala! Person pikin listen oh! I repeat fear God, e go cover you
Wahala! Person pikin listen
Ten commandments for the street oh
If you wan survive, make you follow am
Ten commandments for the hustle
Na the code wey go guide you
E choke! E choke!
Ten commandments oh!
Now you sabi the code!
Follow am well well
No cap! Focus on the bag
Because no excuse for brokenness
On God shut out to people wey dey support me you will never lack