E choke!
Wahala for who no sabi!
Dem say I dey craze
But I dey see things wey dem no see
My head correct pass
Na dem no understand the vibes wey I carry
I dey move different, I no dey follow follow
Star way I be, e dey shine for my eye
Make dem talk, make dem yarn
Me I know wetin I sabi
I dey craze dem say
Na star, na star I be oh!
I dey craze dem say
Na star, na star I be!
See this one oh!
No cap, no cap at all!
I dey craze dem say
Na star wey dey shine!
From morning till night
I dey do my thing, I no send anybody
Dem fit talk anyhow
But the ginger wey I carry, e no fit quench
Mo gbe! Person pikin!
I scatter anywhere I enter
Crazy but I'm gifted
E be like say madness and greatness na cousins
I dey craze dem say
Na star, na star I be oh!
I dey craze dem say
Na star, na star I be!
Omo see level!
Baddest!
I dey craze dem say
Na star wey dey shine bright!
Shut out to those who believe that
I deliver like WhatsApp massage because giving up is a sin
Grinding till my enemies will start asking me for location that's the goal
No cap
Orlando no time wasted
Na star I be!
Chale!
E don do!