Father... I dey come as I am oh
Hallelujah...
God I no dey come perfect today
I dey come as I am, tired and pained
Distracted but still here, standing in your presence
Some days I feel strong but today I just feel human
Empty and dry, like well wey don run dry
Things wey I no understand
Battles wey I dey fight for my mind
Battles no one fit see
But you dey see me, you see the pressure I carry
Meet me here, meet me here
Quiet the noise for my heart oh
Silent the noise for my head
Silent the noise for my heart
Let me see you, let me meet you
Like Jacob I no go let you go
Unless you bless me, change my name
I dey stand right here, meet me!
You see the moments I almost give up
You see when I keep going even when I feel empty
Like lost sheep, abeg search me
Like prodigal son, find me oh
Like Hannah for Shiloh, meet me
No friends to run to, no family members
I dey alone like man for empty hall
Dey scream for help
Meet me here, meet me here
Quiet the noise for my heart oh
Silent the noise for my head
Silent the noise for my heart
Let me see you, let me meet you
Like Jacob I no go let you go
Unless you bless me, change my name
I dey stand right here, meet me!
Father... I need you
Meet me here oh
Amen