Dis Life No Balance
Verse 1
Dis life no balance Blakk Pot, I swear e no equal
Why di war? Who dey feed di evil?
Greedy people everywhere, hand red like devil
Fighting and killing innocent children for medal
We come empty—see my hand, nothing dey
Empty we must return, dat's di only truth we keep
So why di violence? Why di long grieve?
If death na di landlord, why we pay rent with teeth?
Stop di fight, stop di fight, make di gun fall down
Make di world a peace-loving ground
Children dey cry, wailing for di night
Women dey moan, widows without light
Oh Mr. Man, tell me true, tell me straight
Wetin you killing for before you meet your fate?
Na di land you dey fight for?
Land wey go still stand when your chest na cold floor
Na di property you dey kill people?
Gold wey go change hands when your story don full
You don ever think of dying?
No be di hero's death dem dey sell you while lying
But di real one—quiet, alone, no more trying
Your children dey ask, "Why Daddy never stop flying?"
Flying bullets, flying planes, flying rage
Same grave for di fool and di sage.
Stop di fight, stop di fight, make di gun fall down
Make di world a peace-loving ground
Children dey cry, wailing for di night
Women dey moan, widows without light
Oh Mr. Man, tell me true, tell me straight
Wetin you killing for before you meet your fate?
Mama tears no dey water flags
Blood no dey turn to peace for bags
If you die today, who go carry di lag?
Your enemy pikin? No, your own pikin dey drag
Di coffin small, e no need for land
E no need for oil, e no need for command
So before you pull dat trigger with your right hand
Remember: empty, we return to di sand.
We come empty…
We must return…
Put down di weapon.
Di war never love you back.
Blakk Pot to di world