Chai... e pain me oh
Make I talk am
I give you everything, my heart, my time, my all
I sacrifice my peace just to see you stand tall
I give you freedom, make you fly like bird for sky
I teach you plenty tinz, I share my wisdom, no lie
But you no see the love wey dey inside my eye
You dey look another side while I dey wonder why
People talk, dem warn me say "broda watch am oh"
But I been loyal, I been solid, steady loving you so
I never know say tinz go turn this wayy
After all the love I show, you just comot go away
I never know say tinz go turn this wayy
Now I dey here dey wonder how e reach this day
Omo, I have been fucking with oLsssss
But none of dem ever break my heart like this
I have been fucking with oLsssss
But you, you different, you the one wey cause this pain
I treat you right, I no dey play with your respect
I hold you down when life been rough, I been your safety net
But your heart been cold, e no dey beat for me at all
I been dey climb mountain while you been planning how to fall
Now I dey here, I dey reflect on wetin I miss
The signs been clear but love make person act like this
Dem talk true, dem see am from the start
But I been stubborn, now you done scatter my heart
I never know say tinz go turn this wayy
After all the love I show, you just comot go away
I never know say tinz go turn this wayy
Now I dey here dey wonder how e reach this day
Omo, I have been fucking with oLsssss
But none of dem ever break my heart like this
I have been fucking with oLsssss
But you, you different, you the one wey cause this pain
E pain me die... but I go dey alright sha
Life go on... no wahala
Chai