Mr President sir
Sam Fortune dey here
I wan talk true talk
Abeg make you listen
You promise us light, we still dey darkness
NEPA no dey show, generator don tire
You talk say e go better, we still dey suffer
Graduates dey road, no job for anywhere
Hunger dey the land, person no fit chop belle full
Corruption dey reign, na who you know
Ordinary man dey cry, nobody dey hear am
Mr President, wetin we go do?
Mr President abeg oh
Make you remember your promise oh
We need good life, we need security
Make hospital dey work, make institution stand
Protect your people, na your job be that
You fit be hero, or you go be zero
The choice na your own sir
Mr President hear our cry
Young man finish school, degree for hand
No work, no hope, frustration dey kill am
Thieves dey operate, nobody dey safe
Kidnappers dey the road, fear dey everywhere
The system don spoil, everything scatter
But sir, you still get power to change am
Make hospital get medicine, make school get teacher
Make road dey good, make life sweet small
Mr President abeg oh
Make you remember your promise oh
We need good life, we need security
Make hospital dey work, make institution stand
Protect your people, na your job be that
You fit be hero, or you go be zero
The choice na your own sir
Mr President hear our cry
History go judge you sir
You fit change the story
From Sam Fortune and all of us
Mr President, we dey wait
North are watching! East, south and west are watching you!
You will soon be addressed as former president! You can't be there for life Mr president!
We had faith on you before you got there but now everything is scattered Sir
Fortune is begging sir
Sam fortune is begging sir
Write your name in our hear as a true leader when you are not longer there