The way you enter my heart no be small thing o
My broda tell me say I don fall
But I no fit deny wetin I dey feel
Every time wey I look your face
My belle dey do me kpata kpata
You be the one wey I don dey find
Since when I young I know say na you
I love it when you kiss me
It makes me fall more and more
You be the love of my life omo
I know am from the start
The moment wey I see you
You find place in my heart eh
I just dey pray make you no break me
Make you no scatter my world o
You be the love of my life
Baby na you I go choose
They say love no get manual
But with you everything just dey clear
You fit wound me tire I no go complain
As long as na you wey hold the knife
I don give you the key to my soul
Abeg use am well well make e no spoil
I know say I dey vulnerable
But for you I go risk am all
You be the love of my life omo
I know am from the start
The moment wey I see you
I find place for my heart eh
I just dey pray make you no break me
Make you no scatter my world o
You be the love of my life
Baby na you I go choose
Omo e choke!
Na you be am
From the start o