Frobits
🎵 A song made on Frobits

Enough Is Enough (Remix)

0:000:00
Download
Reply with a song
Lyrics

Intro;
Daixie Bankizill here again, Om'Oba Kétu on the Mic.
Ahhh…
Nigeria gbọdọ dara o…
Too many tears for innocent people…
Children crying… mothers praying…
This wickedness must end!
---
Enough is enough o!
Stop the killing of innocent souls o!
Kidnapping children, teachers, worshippers
God Almighty dey watch all!
If na politics dem dey play
Dem go surely fall and fade away
Nigeria go rise again
Light go shine, shame go catch evil men!
---
See as mama dey cry for road
Pikin no fit sleep for house again
Teacher dey fear to go school
Pastor dey pray with fear again
Ki lo ṣẹlẹ̀ sí ilẹ̀ wa?
Why blood full our fatherland?
Bad people wan use fear rule us
But truth and prayer go still stand!
---
No be by terror
No be by gun
No be by evil manipulation
God pass them all!
Who dig pit for innocent people
Na inside dem go enter
Justice no dey sleep forever
Ẹni burúkú lójú máa tì!
---
Enough is enough o!
Stop the killing of innocent souls o!
Kidnapping children, teachers, worshippers
God Almighty dey watch all!
If na election wicked game
To scatter Nigeria’s name
Every evil plan go fail
And peace go finally prevail!
---
Ọlọ́run má jẹ́ kí
Bandits rule our nation
We need peace and unity
Not fear and destruction
North and South, East and West
Na one Nigeria we get
Muslim and Christian together
No let evil divide us forever!
---
Father protect the children
Protect every teacher
Protect churches and mosques
Protect every farmer
Expose every sponsor of evil
Scatter every wicked agenda
Let the poor breathe again
Let Nigeria smile again!
---
Enough is enough o!
Nigerians don suffer too much o!
No more tears, no more fear
Better days must appear!
Shame to the enemies of peace
Their evil kingdom go decrease
Nigeria will stand again
And joy go reign from coast to plain!.
---
Daixie Banks Bankizill Om'Oba Kétu tell them again.
Omo mi Bankkie-Praise Olamide I sight you! Donald-Banks and Jesukorede how una dey?

More songs by Daisy Listen to songs created by others
FROBITS