IGBAGUN COMMUNITY,
HIS ROYAL HIGHNESS OBA SHOLA ADEBOLA SAM AKA GADAFI
AMBASSADOR ENIKAOLAYE
SIR FEMI ADEYOMO
PRINCE RAJI
PRINCE TAIRU
PRINCE TOBA
make we join hand oh
No more wahala, no more fight
Listen...
No alter alternative to peace
We be one family, no matter who you are
Why we dey fight when we fit relate?
Peace and love na the only way to elevate
Omo, make we drop the stone, make we drop the vex
Think of the pikin wey dey suffer next
Ko si wahala, we want peace for the land!
Every broda, sista, make we hold hand!
No more division, no more bad belle
Let the love flow make the story sweet to tell
Yeah, peace for the land oh!
Abeg, let the anger pass away
We want to see a better, brighter day
No need to query who ilai, ejuku, ife, okeagi or mopa
One blood, one hope, one kingdom
Ko si wahala, we want peace for the land!
Every broda, sista, make we hold hand!
No more division, no more bad belle
Let the love flow make the story sweet to tell
One love...
No wahala at all...
Peace...
Kabir write this