Oya clear road,this song is dedicated to my queen abiodun temidayo olabode
Today na your day, my queen
Abeg make the whole world know
Since you enter my life, everything dey make sense
Your grace dey shine bright, no competition
Virtuous woman, that's my definition
You hold down the home with love and wisdom
Every single day, you dey prove your worth
Making miracles from nothing, omo, you dey deliver!
Happy birthday to you my wife
My angel, my heartbeat, my life
You dey carry this home like you born am
I celebrate you, no cap, forever and always
Your kindness na medicine for my soul
The way you love our family, e dey show
You dey humble but your power dey show
Every sacrifice you make, I know
You deserve the world and more, walai
Today i celebrate the woman wey get me covered like assurance
Happy birthday my wife
My angel, my heartbeat, my life
You dey carry this home like you born am
I celebrate you, no cap, forever and always
E choke! See the way you dey glow
Your beauty go beyond the physical, nna
Your heart pure, your spirit strong
This day belongs to me and you alone
Happy birthday, my virtuous queen
I thank God for you every single day,
May God bless you forever ameeeeeeeeen